Wia dis foto come from, Inec Nigeria/X
One judgement by di Justice Mohammed Garba of di Federal high Court Abuja, don nullify plenty provisions for di timetable wey di Independent National Electoral Commission (Inec) bin release for di 2027 general elections for Nigeria.
Na on Thursday, 21 May, 2026, tori pipo get certified true copy of di judgement but na on Wednesday, 20 May di judge deliver am, afta one political party – Youth Party – carry di mata come court.
Youth Party argue say Inec bin do too much pass wetin di Electoral Act 2026 authorise dem to do, by fixing some kain deadlines wey dem say parties must to obey ahead of di election.
End of content
For di mata for court, di Youth Party – wey be one of di registered political parties for Nigeria – accuse Inec of di following:
Sake of dis errors wey Inec allegedly commit, di Youth Party ask di court to nullify di time frames wey Inec bin impose for dia revised 2027 general election timetable, especially di ones wey concern di conduct of primaries by political parties, di submission of personal particulars of candidates by dia parties, di withdrawal and replacement of candidates, di publication of final list of candidates and di period of campaign for di elections.
Di lawyers for di mata na J.O Olotu wey represent Youth Party abd Sarafa Yusuf for Inec.
Justice Umar wey be di trial judge agree wit all di submissions wey Youth Party present for court, and e give order say Inec no fit put for di 2027 election timetable wetin di Electoral Act no give dem power to put.
Diafore, di judge go ahead to nullify di timeframes wey Inec put for di timetable wey concern di issues in contention.
Inec neva tok anytin about dis latest development.
E neva clear weda Inec go appeal dis judgement, but as e be now, e mean say chance fit still dey for pipo wey no dey happy wit dia party to comot enta anoda one.
For dia revised timetable for di 2027 general election, Inec bin fix deadline say evri party must to submit dia membership register on or bifor 10 May, 2026.
"Di register of party members must be submitted to Inec not later dan 21 days bifor di holding of dia respective primaries," di electoral body bin tok for one of dia statements.
And di time frame wey Inec bin fix for parties to hold dia primary election na betwin April 23 and May 30, 2026.
But dis court judgement tok say: "Di timeframe prescribed by di defendant (Inec) for submission of membership registers for di conduct of primary elections, no dey applicable to primary elections conducted for di purpose of replacing candidates wey withdraw".
Di judgement fit also mean say:
Reacting to di judgement, di African Democratic Congress (ADC) wey be di join bodi opposition movement for Nigeria, tok say many members of di ruling All Progressives Congress (APC) go comot from dia party.
Bolaji Abdullahi wey be di ADC tok-tok pesin tok say dem bin don raise complain wit di election timetable wey Inec bin release, but e sweet dem now wey court do make ogbonge pronouncement on top am.
"Di decision of di court na welcome vindication of our position," oga Abdulahhi tok.
"We believe say dat particular restriction bin dey designed to prevent pipo make dem no leave di ruling party, APC.
"Now wey di court has rule against am, we sure say, for di coming days, we go witness mass exodus from di ruling party."
Di APC also neva make any official statement about dis judgement.
Wia dis foto come from, Inec
Youth Party na one of di registered political parties for Nigeria but plenty pipo no even know say dem dey.
Dem describe diasef for dia website as a Party "wey dey made up of individuals and groups wey dey seek to serve and unite Nigerians".
"Our goal na to develop and improve di standard of living of all Nigerians," di party tok for dia 'About Us' page for dia website.
Inec bin first register di party official for August of 2018 just ahead of di 2019 general elections,
However, afta di elections, in 2020 Inec deregister Youth Party plus more dan 70 oda parties wey dem tok say dem no longer meet di criteria wey include, dem no win at least 25 percent of votes for any state during a presidential election or 25 percent of votes for any local government area.
Inec also say di parties no win at least one ward for any local govment chairmanship election, or one seat for di national or state assembly election or even one seat for councilorship election.
But di Youth Party carry di mata go court to ask Inec to revese dia deregistration. Dem win for di high court but Inec carry di mata to di court of appeal and win. YP den carry di mata to Supreme Court wia dem also get judgement in dia favour.
Las las, in July 2023, Inec announce say dem don recognise di Youth Party again as registered political party for Nigeria.
For di Inec website, di names of di acting National Chairman of YP na Dr. Umar Muhammed while dia acting National Secretary na Mrs Helen Adoh.
© 2026 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.